Gloo

Gloo

AD

09 September, 2013

MAKE UNA SEE THE PICTURES OF AMERICA RAPPER DMX AS HE RUN COME OUT FROM ONE HOTEL NAKED


DMX na popular America rapper/actor.DMX show for surveillance video as he they run come down from one hotel hallway without he clothes last week.Only God know watin they pursue am because he run come out from the hotel naked

07 September, 2013

ANNA BANNER THEY FOR INDONESIA AS SHE GO REPRESENT NIGERIA FOR MISS WORLD BEAUTY PAGEANT



Anna Banner na win The Most Beautiful Girl In Nigeria 2013.So she don go Indonesia for another competition as she go there go represent Nigeria for Miss World Beauty Pageant 2013.I WISH HER GOODLUCK OOO

MAKE UNA SEE THE PICTURES OF MKO ABIOLA PIKIN FOLASHADE WEY MARRY LAST WEEK

Late MKO Abiola
Folashade and Serdan Banjac

Folashade and Serdan Banjac
Folashade
Folashade mum in pink (Dr. Mrs. Gloria Abiola)
Folashaed and her aunt Mrs Vivian Ayorind
This na the pikin of Late MKO Abiola Folashade.She marry her bobo for dis August wey pass.She be  lawyer for US Treasury. Her bobo name na Serdan Banjac wey dey work for one US Senator Dere wedding na for one kain ogbonge ceremony for Chateau Cocomar, Houston, Texas for August 31 and September 1.HAPPY MARRIED LIFE TO FOLASHADE

06 September, 2013

MAKE UNA SEE THE PICTURES MAY COME FROM EMMEM ISONG BIRTHDAY PARTY YESTERDAY


Ini Edo and Clarion  Chukwurah
Ini Edo
Mbong Amata
Desmond Elliot

Emem Isong
Mbong Amata and Emem Isong

Austin Nwaolie and Desmond Elliot
Emem Isong na producer and the CEO of Royal Arts Academ.Emem na September 5th pikin so she come celebrate am that same yesterday in Bayelsa because she they for Bayelsa they shoot film.Though many people no know but the ones may know come celebrate with her.Actors and actresses full there yesterday both the ones may they there and the ones may come from Lagos.Desmond Elliot.Ini Edo,Clarion Chukwurah,Austin Nwalie,Mbong Amata all they for there that yesterday.HAPPY BIRTHDAY TO EMMEM

THIS NA THE PICTURES OF BEYONCE AND HER FAMILY ON HER BIRTHDAY AS THEY GO JOLLY







I tell una on Wednesday say Beyonce turn 32 years that day.So she,her husband and their little pikin go celebrate am for beach in Italy.

05 September, 2013

MAKE UNA SEE THE PICTURES OF THE WOMAN MAY GET THE WORLD BIGGEST BREAST









This one no be small thing ooo because watin this woman carry for front so too much Loll.This woman na German woman.She be 32 years old.Na she break the Guinness book of record as the woman may get the biggest breast  for the whole wide world.Her breast no be fake ooo as some ladies go they pump their own out.This one na natural