Gloo

Gloo

AD

23 August, 2013

COSSY TALK SE ONE PERSON GO MISS THE LOAD SHE CARRY FOR FRONT


THE NOLLYWOOD ACTRESS INI EDO AND BABY BABY DON TRAVEL OUT FOR THEIR HONYEY MOON

This one no be small julification oooo.The actress Ini Edo and her husband they go Obodo Ibo.According to wetin she talk,she sey they go go plenty country or places like Paris,Monaco and even UK she con add am se this no be the first time may she and her baby baby go travel out oooo,se this na the 2nd or 3rd time may they go go spend their honey moon.I WISH THEM SAFE JOURNEY OOO

MERCY AIGBE DON COME AGAIN AS SHE COVER HOUSE OF MALIQ EXCLUSIVE


This Nollywood actress no wan gree at all cos her swag too much.Mercy Aigbe don com again as she covers House Of Maliq Exclusive

22 August, 2013

MAKE UNA CHECK OUT THE NEW PICTURE OF YVONNE NELSON

This babe just dey release everyday and as she dey release new pics,na so she dey shine dey join nam.

OUR NIGERIA DANCER KAFFY DON GET BELLE AGAIN

Kaffy our own Nigeria dancer don carry another belle give her husband well na her husband put am for there Lol.Na her second time be this and we pray may God give am safe delivering when the time come

MAKE UNA SEE THE PICTURE OF OMOTOLA AND HER FAMILY

If person may never get family see this lovely family,the person go quick go marry kiakia.Anyway,the Nollywood actress Omotola share this picture of her family as they dey on vacation forRome

MAKE UNA SEE THE PICTURES WEN THEY TAKE YESTERDAY FOR NGOZI NWOSU BIRTHDAY PARTY

We thank God se the Nollywood actress Ngozi Nwosu don finally recover from her kidney failure and heart problem.She be August 1st pikin and na that day she turn 50 though she celebrate am but her fellow Nollywood actors and actresses con throw small and big party for their own person  yesterday the 21st of August for Eagles Park, Obokun Close in Ikeja.Though he don pass,but we still wish her HAPPY BIRTHDAY .