Shee Na For Newz,Gossipz,Fashion,Entertainment And Even Event We Full Ground Remain
Gloo
AD
22 August, 2013
MAKE UNA CHECK OUT THE NEW PICTURE OF YVONNE NELSON
This babe just dey release everyday and as she dey release new pics,na so she dey shine dey join nam.
OUR NIGERIA DANCER KAFFY DON GET BELLE AGAIN
Kaffy our own Nigeria dancer don carry another belle give her husband well na her husband put am for there Lol.Na her second time be this and we pray may God give am safe delivering when the time come
MAKE UNA SEE THE PICTURE OF OMOTOLA AND HER FAMILY
MAKE UNA SEE THE PICTURES WEN THEY TAKE YESTERDAY FOR NGOZI NWOSU BIRTHDAY PARTY
We thank God se the Nollywood actress Ngozi Nwosu don finally recover from her kidney failure and heart problem.She be August 1st pikin and na that day she turn 50 though she celebrate am but her fellow Nollywood actors and actresses con throw small and big party for their own person yesterday the 21st of August for Eagles
Park, Obokun Close in Ikeja.Though he don pass,but we still wish her HAPPY BIRTHDAY
.
21 August, 2013
MAKE UNA SEE THE WOMAN WITH THE WORLD LONGEST DREADLOCK.

This woman name na Asha Mandela.Na she break the Guinness book of record in 2008 for the world's longest dreadlocks.Asha na 5o years old woman who don marry so te she con finally decide to settle down with her 3rd husband.This woman dey live for Atlanta and dey con talk sey her dreads measure19 feet, 6 inches long.He don te since she don dey grow her hair since wen she be 25 years old and she con also talk am for an interview se she cut the hair so te the dread tire am and the dread still dey grow before she con get am for mind se if she cut am again,se she go die. Na she con also talk se whenever she wash the dread,he dey take 2 better days to dry and the weight of the dread when he wet no be small thing ohhh as he dey weigh 25 pounds.Well,doctors don tell Asha se may she cut the dread because make he no for curse sickness but she no wan cut am.
MAKE UNA SEE THE PICTURES OF JESSE JAGZ CAKE
![]() |
| Jesse Jagz |
This guy don really go gaga with dis he cakeLol.Anyway,he name na Jesse Jags the small brother of MI and one of the former artist of Choc City.This musician celebrate he own birthday with all his friends on the 10th of August 2013.The 29 years old pikin use one kind funny cake do he birthday but all the same,the cake make sense as he share the photo for he own instagram page.Though he don pass,HAPPY BIRTHDAY JESSE
Subscribe to:
Posts (Atom)










